Senegal vs Egypt penalty shootout: Sadio Mane score last penalty to help Senegal win Afcon 2021

Cbssportsmyid

Mane

Wia dis foto come from, Getty Images

Senegal talisman Sadio Mane score di decisive kick to help di Teranga Lions win dia first Africa Cup of Nations Crown.

Di Liverpool forward score di last penalty to give Senegal victory afta im bin miss one during regulation time.

Senegal bin don lose out from di last two times wey dem bin appear for di final and e bin look like dia wait for di trophy go kontinu as dem meet inspired goalkeeping from Egypt goalkeeper Gabaski.

Afta both teams bin dey deadlocked for normal time and extra-time, di game enter penalties wia Egypt players – Abdelmonem and Ashin both miss dia kicks.

Mane na im go steal di headlines but di Senegal team also get Edouard Mendy to tank too as na im save Lasheen kick to put di Teranga Lions ahead for di shootout.

Di Egyptians and Gabaski in particular go dey disappointed wit di outcome of di shootout as di goalkeeper bin don save Bouna Sarr kick.

Disappointed Pharaohs go try dia luck to win dia eight Afcon title for di 2023 edition wey Ivory Coast go host.

Penalty shootout

Di game don enter penalties and na Senegal go take di first kick.

Koulibaly shoot down Gabaski rightm di goalkeeper punch am enter net. 1-0

Zizo step up for Egypt, im beat Mendy, 1-1.

Next up, Diallo coolly slot di ball into di net, 2-1 Senegal.

Abdelmonem hit di post. Di first player to miss so far afta two takes. Senegal 2-1 Egypt.

Bouna Saar to take Senegal third kick, Gabaski save am. Wow!

Hamdy step up next and im score, Senegal 2-2 Egypt.

Bamba Dieng send Gabaski go di wrong way, Senegal 3-2 Egypt.

Mendy save Lasheen fourth kick, all Senegal need do na to score dia next penalty and win di cup.

Mane! Scores! Senegal don win Afcon 2021. E finish Senegal 4-2 Egypt.

106mins: So who go score di first goal for dis match? Na di question we dey wait to find ansa from di players as di second half of extra-time don start.

108mins: Saliou Ciss foul Zizo as im attempt to clear ball inside im own half. Koulibaly boot di ball clear from di freekick.

111mins: Di match don dey witness more fouls from both sides as di game gradually dey approach penalty shootout.

114mins: Salah try to lead attack for Egypt but find Koulibaly for im way as di Napoli man shield di ball well afta im win am.

116mins: Gabaski make anoda good save to deny Bamba Dieng! Di Marseille man shot from 20-yards see di Egypt goalkeeper use one hand to push di ball go wide.

117mins: Di corner dey cleared by Egypt and dem lead attack of dia own wey see Mendy push ova Zizo goal bound attempt.

118mins: Dos two chances don bring di game to life as di fans don begin ginger dia teams.

120mins: Game Over! Na penalty shootout go decide dis game as di match end Senegal 0-0 Egypt for normal time.

91mins: Extra-time don start and straight from di restart Senegal create good chance.

Bamba Dieng race through Egypt defence come shoot inside di box, but Gabaski dive low to save im effort to di bottom right corner.

96mins: Hamdy foul Mane come kick di ball away afta referee don blow whistle.

99mins: Substitution – Fathi wey bin don receive yellow don comot, Mohammed Ashin don enta.

100mins: Trezeguet nicely control Zizo cross inside Senegal penalty area, im try to shoot but no hit am well.

101mins: Chance! Bamba Dieng head Ciss cross goalwards but Gabaski save di ball go out for corner. From di corner, Diallo head wide.

Di Egypt goalkeeper na di only tin wey dey prevent Seb=negal from taking di lead as im don produce good saves for dis match.

104mins: One minute before half-time in extra-time. Mane try to win foul from di edge of Egypt penalty box. Referee Gomes rule say di Liverpool forward dive, instead blow for goalkick.

105mins: Half-time in extra-time. Di scoreline still remain Senegal 0-0 Egypt.

Second half

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Egypt and Mohammed Salah dey defend well but dem never create much to trouble Senegal

46mins: Egypt restart play and quickly lose di ball as Senegal press dem. Mane win foul from just outside di box.

48mins: Gana Gueye shot from di freekick go over.

53mins: Senegal threaten to take di lead from dangerous Sarr into di box but Gabaski quickly take control of di ball as Diedhiou and Mane try to steal am from im hand.

54mins: Foul on Salah by Abdou Diallo see di Senegal defender collect yellow card.

58mins: Triple change for Egypt. Coach Carlos Queiroz send ON Zizo, Marwan Hamdi and Trezeguet for Marmoush, Mostafa Mohammed and El Solia.

59mins: Mahmoud Hamdi wey just come on commit foul to interrupt di attacking move of Senegal, im collect warning by di referee. Di freekick no result to any chance for di Teranga Lions.

62mins: Senegal dey control di game wit 53% possession, Egypt get 47%.

66mins: Substitution – Pape Gueye replace Kouyate.

69mins: Abdelmonem of Egypt jump high to head cross from freekick. Na di first time wey Egpy go try to create chance for dis second half.

75mins: Hamdy wit good chance! Im jump high inside di penalty box and attempt to head di ball into di net. Di forawrd fail to produce any accuracy as di ball go wide.

76mins: Substitutions for Senegal – Bamba Dieng and Boulaye Dia don come ON for Famara Diedhiou and Ismaila Sarr.

78mins: Dia race down di left come cross di ball back inside Egypt eighteen but nobody dey dia to put di ball into di net.

81mins: Gabaski dey down injured, referee Gomes don stop di game. Afta some treatment di goalkeeper dey able to kontinu.

88mins: Yellow card for Sadio Mane for im challenge on Ashour.

90mins: Hamdy foul Ciss as referee add three minutes. We go play extra-time if di game end 0-0.

Full time: Dis two teams don fail to find di opening goal as di mtach now go enter extra-time.

First half

1min: Idrissa Gana Gueye take di first kick of di gam as referee Victor Miguel de Freitas Gomes signal start of di game.

3mins: Penalty! Senegal don win early penalty as Abdelmonem foul Ciss inside di box.

5mins: Freitas Gomes show yellow card to Mohamed Abdelmonem for im foul.

7mins: Gabaski save Mane penalty. Di Egyptian goalkeeper guess right as im strong hand keep out Mane shot from giving Senegal di lead.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto,

Gabaski deny Mane from giving Sengal di lead as im save im penalty

8mins: Senegal take di corner but e no lead to any tin.

11mins: Ismaila Sarr shot from outside di area see Gabaski produce easy save.

16mins: Nampalys Mendy collect yellow card for im foul on Marmoush.

19mins: Sarr make good run down di left flank, im cross wey into di box no meet anyone .

Senegal get di upper hand so far despite dat early penalty wey Mane miss.

23mins: Anoda dangerous cross from Sarr into di box see Mane fail to meet di ball as im attempt to connect.

Di Watford man dey cause Egypt trouble down dia left side.

25mins: Koulibaly foul Mustafa Mohammed for near di half-way line. Egypt quickly take di freekick but Marmoush attempt to trap di ball no work.

27mins: Senegal dey knock on Egypt door – dis time El Fotouh use diving header to clear Ciss cross into di box.

28mins: Egypt don get dia first attempt on target. Star man Salah dribble three players before im shoot goalwards, di shot no get power as Edouard Mendy save am well.

33mins: Tournament top goalscorer, Vincent Aboubakar dey stadium. Di Cameroonian don score eight goals so far for di competition.

37mins: Referee Gomes give Fathi yellow card. Di midfielder foul Mane.

38mins: Diedhiou jump high to meet wit di freekick, Gabaski catch im header.

40mins: Five minutes before half-time. Di game bin dey stopped as Nampalys Mendy bin fall down dey hold face.

42mins: Mohammed Salah produce hot shot from tight angle but Mendy dey equal to am as im parry di ball go corner.

45mins: Senegal captain, Koulibaly collect yellow afta referee say im foul Mostafa Mohammed.

We don enter into two minutes added time.

45+1mins: Cheikhou Kouyate go close wit long range shot afta di ball fall to am from attempted clearance by Hamdi.

Half-time: Senegal 0-0 Egypt.

Senegal vs Egypt lineup

Senegal: 16. Mendy, 20. Sarr, 3. Koulibaly, 22. Diallo, 2. Ciss, 8. Kouyate, 6. Mendy, 18. Sarr, 5. Gueye, 10. Mane, 19. Diedhiou.

Egypt: 16. Gabaski, 8. Ashour, 2. Abdelmonem, 15. Hamdi, 13. El Fotouh, 17. Elneny, 5. Fathi, 4. El Solia, 10. Salah, 14. Mostafa Mohamed, 22. Marmoush.

Leave a Reply

Next Post

Winners and losers from signing days

The arrival of an early signing working day in December has considerably altered the recruiting landscape in college soccer. No for a longer time is the first Wednesday of February the watershed working day when the broad greater part of major recruits set pen to paper on their countrywide letters […]

Subscribe US Now